Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 38:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 Yet, my enemies still dey set trap to kill mi. Pipol wey hate mi dey plan to skata my life and na evriday dem dey plan against mi.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 38:12
18 Iomraidhean Croise  

“God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi.


Like lion wey hide for korna, na so dem dey wait to kill innocent pipol. Dem dey katch and drag innocent pipol for dia net like hunta wey katch animal.


Even doh wiked pipol set dia trap for mi, I nor go turn from yor kommandment.


Proud pipol don set trap to katch mi; dem spread dia net and dia trap dey evriwhere for di road.


Make Yu keep mi from di trap wey dem don set for mi; di hole wey wiked pipol dig.


Pipol don forget mi like sey I don die; like sey I bi pot wey break.


Dem nor dey tok about peace. Dem dey plan against innocent pipol wey dey mind dia business.


Make shame and disgrace follow pipol wey dey try to kill mi; make Yu drive dem back and disgrace doz wey won wound mi.


Na only bad-bad tins my enemies dey tok about mi. Dem dey ask, “Wen e go take die make pipol forget am?”


Bikos strenjas dey attack mi; wiked pipol dey try to kill mi and dem nor kare about God.


True-true, di love wey I get for yor house dey shark mi; so I dey bear di curse wey dem dey curse mi.


My own tears don blind my eyes. My God, evriday I dey beg make Yu kom help mi; I lift my hand to Yu make Yu sorry for mi.


Man wey nor get money, nor get value for en brodas hand, even en friends dey run from am. Aldo e dey beg dem, but dem nor dey ansa am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan