Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 37:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 God go distroy wiked pipol, but na doz wey trust God, go inherit di land.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 37:9
17 Iomraidhean Croise  

Dem go prosper and dia shidren go inherit di land.


Doz wey dey fear God go inherit di land and dem go stay der forever.


But Yu, my Oga God! Yu go send wiked pipol go di pit where distroshon dey. Doz wey dey kill pipol and doz wey dey lie, go kwik die, but as for mi, I go trust di Oga, wey bi my God.


Raitious pipol and doz wey get respet go stay for di land wey bi awa own.


Wen una kry for help, make una juju kom save una. Na one small breeze go karry dem go! But pipol wey trust mi go stay di land kon woship mi for my temple forever.”


den una go si di joy wey go follow una as una dey serve mi. I go make dem honor una for di whole world and una go enjoy di land wey I give Jakob wey bi una grand-grand papa.” Na mi wey bi God tok all dis tins.


Una pipol go do di rite tin and dem go get di land forever. Na mi plant and make una, so dat evribody go know how I great rish.


Oga God sey, “True-true, Judgement day dey kom; e go kom like strong fire. All doz sturbon and wiked pipol go fall and dat day dem go burn die. Both dia rut and branches go burn finish.


God don tok about dem sey, “Dem go must die for di wildaness.” And nobody among dem go remain, escept Kaleb wey Jefunneh born and Joshua wey Nun born.


Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.


But as tins bi so, dem dey espect kountry wey betta pass dia own and e dey kom from heaven. Naim make God nor shame wen dem dey koll am dia God, bikos E don build big town for dem.


Dat day, Moses kon promise mi, ‘Any land wey yu waka enter, go bi yu and yor family own forever, bikos yu dey loyal to di Oga yor God.’


Yu don choose dem as kings and priests wey go serve God and dem go rule for di eart.”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan