Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 37:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Doz wey dey honbol, go inherit di land and dem go get peace kon prosper.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 37:11
16 Iomraidhean Croise  

Pipol wey love wetin Yu tok, get peace of mind and dem nor dey fear, shake or fall.


Dem go prosper and dia shidren go inherit di land.


Yu dey feed dem from di plenty food wey Yu get for yor own house kon let dem drink from yor wota wey dey give life,


All di pipol wey dey fear God go prosper as di king dey rule. So make goodness follow dem, as long as di moon dey shine for di sky.


Oga God, Yu dey guide and save pipol wey dey faithful, bikos dem trust Yu.


If to sey una just gri listin to my kommand, una peace for bi like river and una raitiousness for bi like wave for sea.


Wen una kry for help, make una juju kom save una. Na one small breeze go karry dem go! But pipol wey trust mi go stay di land kon woship mi for my temple forever.”


God go bless una wey nor dey karry body up, una go enjoy en promise for dis world.


Make una mind rest, bikos na my peace I give una. My peace difren from di one wey di world dey give. Make una nor fear or allow anytin worry una mind.


Make una dey do just as E kommand una, so dat una nor go die; evritin go dey well with una and una go stay long for di land wey una dey go.


Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.


But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.


So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.


Who get sense among una? Di way di pesin dey bihave go show di gentolness wey wisdom dey bring.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan