9 Bikos na afta E tok, di world start! As E kommand, di world kon appear at wons.
Wen di world just start, na God kreate di heaven and di eart.
So God kon sey, “Make lite kom.” And lite kon kom!
Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.
My God! Nobody fit shange yor laws! Yor kingdom dey holy and Yu go rule forever and ever.
So, na who fit tok make sometin happen, if God nor allow am?
Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.
Na thru faith wi take undastand sey, God kreate evritin with en word. So di tins wey wi dey si so, na God make dem from wetin dem nor dey si.
“Awa Oga and God! Yu dey worthy to receive glory, honor and pawa, bikos na yu kreate evritin as yu wont.”