But naw, dia face don black pass black powder and wen dem dey waka for street, pipol nor even know dem again. Dia body don tin finish and dem dry like dry wood.
true-true una nor go won wait until dem big rish to marry una! Una nor go fit stay thru-out dat time without husband. Yes! Una nor go fit wait. So my dotas, make una nor follow mi go, bikos my wahala and sofa too many for una to karry and na God dey ponish mi!”
So dem gada all Filistia pipol leaders kon sey, “Make una komot di Oga wey bi Israel God box from dis place! Make una karry am go back to where e dey before, so dat e nor go kill wi and awa pipol!” Di angel wey dey kill pipol dey di town dey waka and God dey ponish di pipol well-well.
But make una dey look am. If only di truck go by ensef to Bet-Shemesh borda, den make una know sey na God give una dis big wahala. But if e nor go like dat, den wi go know sey nor bi en dey give us dis wahala; instead, e just happen to us like dat.”