Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 32:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Wen I nor gri konfess my sins, my body kon dey die go and I kon dey kry with pain.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 32:3
26 Iomraidhean Croise  

Wen e mourn finish, David kon bring am kom di palis and e born boy for am. But God nor like wetin David do.


Instead make I chop, I dey kry and my pain dey pour kom out like wota.


Di nite dey make my bones pain mi; di pains dey bite mi and e nor gri stop.


My skin don black finish and strong fever dey katch mi naw.


My God, my God, wetin make Yu forget mi? Wetin make Yu dey far from mi wen I dey kry for help?


and bikos Yu dey vex, my body nor dey strong again, bikos of my sin.


I don taya and my own don finish. I dey kry from my heart, bikos of all di pain for my body.


My God, make Yu give mi my joy back and make my bones wey Yu break, strong again.


Make Yu sorry for mi, bikos I dey weak. Make Yu heal mi, bikos my bones dey shake.


Happiness dey give yu good life, but sadnes dey make pesin die small-small.


Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi.


Una shidren dey fall and faint street, bikos dem don weak; dem bi like animal wey hunta net katch. Dem don si how God vexnashon dey bi.


I bin dey vex for dem bikos of dia sin and long-trot, so I kon ponish and abandon dem bikos dem sturbon and dey do as dem like.


Dem dey sofa and make us fear. Wi won si God, so dat E go save us from di opreshon and bad tins wey wi dey do, but e nor gri work.


Dem karry Judah pipol go Babilon as slave kon dey sofa dem. Na anoda land dem dey stay and dem nor get peace at-all. Even with di pain wey dem dey pass thru, evribody wey porshu dem, katch and ponish dem.


E don make my skin and flesh old kon break di bones for my body.


I kry well-well make E help mi, but God nor gri ansa mi.


Dem nor dey pray give mi with all dia heart. Instead, dem dey pritend dey kry and take body nak dia bed, just as doz wey nor know God dey do. Anytime dem dey do di korn and wine ofrin, dem dey kut demsef like sinnas and dem nor gri do wetin I tok.


Dem take di bones kon beri dem under di tamarisk tree for Jabesh; den dem kon fast for seven days.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan