2 Yes, make doz wey God don forgive dia sins happy well-well; doz wey dey live betta life naw!
and e nor take am go di tent gate as ofrin to God, e don kill bi dat and e nor go dey among Israel pipol again.
Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”
Sin dey di world before di law kom, but if law nor dey, wi nor go fit judge pipol sin.
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.
Lie-lie nor dey dia mout and dem nor get any fault.