Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 32:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Plenty trobol dey kom meet wiked pipol, but di love wey nor dey fail, dey kover doz wey trust God.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 32:10
20 Iomraidhean Croise  

E go burn wiked pipol with shako, sulfur and fire kon distroy dem with strong breeze.


Make Yu nor allow pipol wey dey lie, prosper for dis land. Make Yu kause betta wahala for doz wey like trobol.


But pipol wey Israel God bi dia helpa and hope, dey inside di Oga God and na joy dey follow dem.


No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am; doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail.


Pipol wey dey run follow oda gods, dia trobol dey plenty evriday. I nor go follow dem do dia blood sakrifice or even koll dia god name.


Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!


Make yu kom try God, den yu go si sey God dey good: Make yu si as God bless di pipol wey bilive am!


Make una si as pipol wey trust God dey happy; doz wey nor like proud pipol or woship juju.


My God, true-true, Yu dey reward doz wey dey fear Yu. Yu dey always protet dem well-well, bikos of yor favor wey nor dey end.


My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu si di blessing wey dey follow doz wey trust Yu.


Doz wey dey like to sin, na trobol dey porshu dem, but na blessing, raitious pipol go gain.


Listin to wetin dem tish yu and yu go dey susesful; make yu trust God, so dat blessing go follow yu.


If pipol wey sin hundred times still get long life, den I know sey pipol wey dey fear God, na dia life go long pass.


But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.


Wiked pipol nor go ever get peace of mind.” Dis na wetin God tok.


Pesin wey love money, go get wahala, wiked and evil tins. Bikos some pipol one get money by force, dem don fall komot from di faith kon wound demsef anyhow.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan