Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 32:1 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

1 Di pesin wey God forgive en wiked ways and sins, make e happy!

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 32:1
27 Iomraidhean Croise  

So David sey, “I don sin against God.” Natan ansa, “God don forgive yu, so yu nor go die.


Make Yu nor forgive di bad-bad tins wey dem do and nor forget dia sins, bikos dem don curse us wey dey build.”


Na-im dey forgive pipol dia sins and dey heal difren-difren diziz.


Joy dey for pipol wey dey do well and always dey do wetin dey rite.


Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand.


Make una si as pipol wey trust God dey happy; doz wey nor like proud pipol or woship juju.


My God, just as deer dey find wota to drink, na so too I dey find Yu.


Na betta words full my heart for di king and I go use my vois praiz am, just as dem dey use biro rite for book.


Yu wey tink sey yu strong, why yu dey karry body for di bad tins wey yu dey do? Yu nor know sey God love dey always protet mi?


Na fools dey tok for dia heart sey, “God nor dey.” Dem don spoil; na bad tins dem dey do and e nor get any one among dem wey dey do good!


My God, listin to my prayer. Nor trowey yor face wen I dey kry for help!


My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu si di blessing wey dey follow doz wey trust Yu.


Yu forgive yor pipol dia sins. Yes! Yu kover all dia sins.


Pipol wey dey woship Yu, dey always dey happy; dem go waka for di lite wey dey yor present, bikos Yu don favor dem.


Afta una don do like dat, den God go sey, “Make una kom make wi setol di matter naw. Even doh una don stain unasef with blood bikos of una sin, I go wosh una white like snow. Even doh una stain red well-well, una go kon dey white like wool.


But na mi wey bi God still dey forgive una sins and I do all dis tins, bikos of who I bi! I nor go kount una sins against una.


I don remove una sins komot like sey na tick kloud. So make una turn kom meet mi, bikos na mi bi di Pesin wey save una.”


Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.


Den Jesus sey, “Pipol wey hear God word and do wetin e tok, na dem God don bless!”


God don bless doz wey wosh dia klot klean, so dem go get authority to chop from di tree wey dey give life and dem go fit pass di gate enter di town.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan