2 Make Yu listin to mi kon kwik diliver mi. Make Yu bi my rock wey go dey protet mi; di strong place where I fit hide put.
Na God dey protet and save mi. Na-im bi my shield and E dey defend mi. E dey protet and save mi from danger.
Yu nor fit just forgive mi my sins? Yu nor fit just sorry for all di bad tins wey I do? I go soon die and wen Yu dey look for mi, I go don go.”
Make Yu nor turn from mi wen I dey trobol. Listin and kwik ansa mi wen I koll Yu.
My Oga God, make Yu listin and hear mi as I dey kry for mesi!
So, my Oga God, make Yu kwik kom ansa mi, bikos my wahala dey worse evriday. Make Yu nor turn from mi, if not, I go die.
Na only Yu I trust, so make Yu nor let pipol disgrace mi or allow my enemies happy wen I fall.
I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi.
My viktory and honor dey kom from God. Na-im dey guide mi and na-im bi my Rock, so nobody fit kom attack mi for der.
Nor leave yor savant, bikos I dey trobol, but make Yu ansa mi naw-naw!
If Yu nor save mi, dem go chop mi like sey dem bi lion and nobody go fit save mi.
My God, strenjas don take di land wey Yu choose as yor own. Dem don spoil yor holy temple kon turn Jerusalem to where dem dey pour dirty put.
My God, make Yu hear my prayer; make Yu ansa and help mi, bikos pipol dey opress mi.
My Oga God, from generashon to generashon na Yu dey protet us!
If una make God di place where una dey hide put; if una make di Most High God where una dey stay,
But na God bi di place where I hide put; na my God mi di mighty rock wey dey hide mi.
Make yu listin and I go tish yu wetin wise pipol tok and as yu undastand wetin dem tok,
na-im go dey save like kountry wey dem protet well-well. E go get food and wota to chop and drink.
I tell una true word, God go help dem kwik-kwik. But wen Man Pikin kom back, e go si pipol wey get faith?”
Di pesin wey chop my flesh and drink my blood, go stay inside mi and I go dey inside am too.
Bikos awa enemies rock nor bi like awa Rock and even awa enemies know sey na so e bi.
Nobody don ever si God before. If wi love each oda, God dey inside us and en love dey pafet inside us.