10 My Oga God, make Yu hear mi kon sorry for mi. Make Yu kom help mi.”
My God, make Yu hear my prayers; make Yu listin as I dey pray! Make Yu ansa mi, bikos Yu dey good and evritin wey Yu dey do, dey rite.
So my God, make Yu hear my prayer. Make Yu show mi mesi!
Na God bi my strent, my guide and I trust am with all my heart. My heart dey happy well-well, bikos God help mi. So, I go always dey sing dey tank am.
But na God dey help mi. Na God dey keep my life!
I don taya to komplain, bikos evry nite, I dey wet my bed with wota from my eyes.