8 Viktory dey kom from God. So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.
but Shammah nor run and e fight and kill all of dem. God give dem viktory dat day.
I bi yor own, so make Yu save mi, bikos I don work well-well to obey yor kommand.
Na God dey give en pipol strent and na en dey bless dem with peace.
Make yor favor shine on yor savant. Make Yu save mi with yor love wey nor dey fail.
Make dem vanish like wota wey dey flow! Make dem dry like grass wey pipol go burn trowey!
Make di king rule forever; make en kingdom kontinue as long as di sun dey shine. Make blessing dey all di nashons bikos of am, so dat dem go praiz am.
Make dem fall with fear. Make Yu let pipol know sey, na ordinary human being dem bi.
Pesin fit ready en horse sey e dey go fight war, but na only God go gi-am viktory.
Yes! Na only mi bi God; di only One wey dey save una.
True-true, hills and mountins nor fit help us. But na only Yu wey bi awa Oga God, go fit help wi, yor pipol.
God sey, “Na mi bi di Oga una God wey take una komot from Egypt. Una nor get anoda God apart from mi. Na mi dey save una.
But as for mi, I go sing praiz Yu; I go offa sakrifice give Yu kon do wetin I promise, bikos na only Yu fit save mi!”
And wen dem karry di box dey travel, Moses go sey, “My God! Arise make yor enemies dem skata and make all doz wey hate Yu, run as dem si Yu dey kom.”
So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”
And na en pawa God dey use save pipol, bikos for di whole world, e nor get any oda name wey get pawa to save pipol, like Jesus Christ own.”
I bless God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa; wey don bless us with difren spiritual blessing from heaven, bikos of Christ.
“Na mi bi Oga God, I go bless yu well-well and yor shidren go plenty.”
Make una nor take bad pay di bad wey pesin do una, instead, make una bless odas, bikos God koll una to bless pipol.
Afta dis tins, I hear wetin bi like many pipol vois for heaven dey sey: “Halleluya! Make salvashon, glory and pawa bi awa God own,
dey shaut sey: “Awa God wey sidan for di throne and di Lamb, na yu get pawa to save pipol!”