So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
Oga God, make Yu raiz-up kon help us! Save us with yor pawa. Make Yu use yor pawa, just as Yu dey do before. Di monsta wey dem dey koll Rahab wey dey di sea, na Yu kut am to pieces.
Curse dey una head! Una dey tell ordinary wood and stone sey, ‘Make una wake-up kon save us!’ Juju go fit tell una anytin? Dem fit make am with silva and gold, but e nor get life at-all.