6 I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well.
David men defeat Israel pipol kon kill 20,000 men dat day.
Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.
Even doh I waka pass di place wey dark pass and where deat dey, I nor go fear anytin, bikos E dey with mi; en rod and staff dey protet and konfort mi.
Bikos of dis, wi nor dey fear wen di eart dey shake or wen mountins dey fall enter sea.
God wey dey lead heaven sojas dey with us and na Israel God dey protet us.
Fear nor go katch yu wen yu dey sleep and yu go sleep well still day break.
Wetin dem tish yu so, go lead yu wen yu dey waka, protet yu for nite kon give yu good advise for day time.
Wetin wi go tok about all dis tins? If God dey for awa side, who go fit dey against us?