until e go kom take una go one land wey bi like una own. Land wey food and wine full, where bread and vineyard dey; betta land wey get olive tree and honey. Den una go live and e nor go kill una.’ “So make una nor listin to Hezekaya, bikos e dey deceive una wen e sey, ‘God go save us.’
For thirty-seven years wen King Jehoiashin dey for Babilon, for di twenty-sevent day for di twelft mont, for di first year wen King Evil-Merodak dey rule Babilon, e sorry for King Jehoiashin kon release am from prison.
Di sun nor go bi una lite for day time again or di moon for nite, bikos na mi, wey bi God, go bi una lite forever and my glory lite go always dey shine on una.
Israel pipol, si as una dey happy! Who bi like una? Una bi pipol wey God diliver, bikos na God dey protet una and na-im bi una swod. Make una enemies kry before una and una go mash dia back pass.”