2 Many of dem dey sey, “God nor go save am.”
If to sey God nor really dey awa side wen pipol attack us,
Anybody wey si mi, dey laf mi. Dem go look mi kon shake dia head sey,
Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill.
Viktory dey kom from God. So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.
Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?
So make yu fear God and nor sin. Make yu tink about am for nite kon turn from yor sins.
Dia wahala don break my bones. Dem dey laf dey sey, “Where dat yor God dey sef?”
I dey kry both day and nite and na tears bi di only food wey I dey chop and my enemies dey tell mi sey, “Where dat yor God dey sef?”
Dem dey sey, “God don rijet am. So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”
Yu go save yor pipol and di king wey Yu choose. Na Yu kill di pesin wey dey lead wiked pipol kon distroy doz wey dey follow am.
God dey kom from Teman; God wey dey holy dey kom from Mount Paran. En glory kover di heavens and na en praiz full di eart.
Yu dey ready to use yor bow kon shot yor arrow. Yor lite for heaven dey divide di eart into two.