7 So my God, make Yu hear my prayer. Make Yu show mi mesi!
I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
My Oga God, make Yu turn kon ansa mi! Make yu give mi strent again or I go die.
Naw, Yu don turn my sorrow to happiness. Yu remove di klot wey I take dey mourn kon wear joy for my body like klot,
I dey die bikos pain and sadnes don make my years short. Sin don finish my strent and na die I dey die so.
My God, make Yu ansa mi wen I koll Yu. Na only Yu go fit diliver and free mi from wiked pipol and all my trobol. Make Yu sorry for mi kon hear my prayers.
My King and my God, make Yu listin to my kry for help, bikos na only Yu I dey pray to.