Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 27:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Even doh strong sojas gada round mi, my heart nor go fear. Even if dem attack mi, I don go shek at-all.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 27:3
17 Iomraidhean Croise  

Jahaziel kon sey, “Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem with Jehoshafat, make una listin! Dis na wetin God dey tok, ‘Make una nor fear, bikos of dis plenty sojas! Bikos di fight nor bi una own, but na God go fight am.’


Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.


Dem nor dey fear bad news; dem always dey trust God sey E go kare and guide dem.


I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well.


My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit!


Doz wey dey do wetin dey rite, go si am kon happy. Dem go laf dey sey,


Make una nor fear una enemies, bikos dem go soon skata and dat na sign to show sey God go save una.


But if yu sofa bikos yu dey do good, make yu nor fear doz wiked pipol, bikos God don bless yu bi dat.


Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.


War kon start again. So David kon go fight Filistia pipol. E win dem well-well and di remainin ones, run from am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan