My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi, bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi. Make Yu remove all di problem wey dey di road wey Yu dey take mi pass,
bikos my enemies nor dey tok di trut. Wetin dey hongry dem to do, na to distroy odas; dia troat bi like open grave and na so-so lie-lie words full dia mout.
One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.
I hear as pipol dey gossip mi. Dem dey koll mi, “Di Man Wey Fear One Kill.” Dem dey treaten sey, “If yu tok anytin here, wi go ripot yu.” Even my friends before, dey look and dey wait make I fall. Dem dey sey, “E go fall enter di trap, den wi go know sey wi don revensh am back.”
Den di Farisee pipol and di law tishas kon dey wosh Jesus well-well. Dem send some pipol go pritend like sey dem dey follow Jesus, so dat dem go fit use en word against am, kon ripot am to di Roman Govnor.