7 kom tank and tell Yu about all di wonderful tins wey Yu don do.
Make una tell di world about en glory and di big-big tins wey E dey do.
Make wi sing to am. Yes! Make wi sing to am. Make wi tink about all di wonderful tins wey E do!
Di gate wey raitious pipol dey pass enter, make Yu open am for mi, so dat I go-go inside go tank God.
Di Oga na God, so make wi start di celebrashon with sakrifice, as wi dey mash round di altar with bambo leaf for awa hand.
Make Yu help mi undastand wetin yor kommandment mean and I go always dey tink about di wonderful tins wey Yu dey do.
Make una raiz una hand for di temple kon praiz God!
I go always dey tink of yor majesty, yor wonderful works and all yor mirakles wey yu do.
Make una praiz di Oga wey bi Israel pipol God bikos of di wonderful tins wey E do and na only en fit do dem.
My God, I go tank Yu with all my heart; I go tok about all di wonderful tins wey Yu don do.
Save mi so dat I go fit praiz Yu for publik for Jerusalem gate. Yes! I go dey happy bikos Yu don save mi.
I go sing with joy bikos of Yu. Di Most High God, I go sing praiz yor name,
As wi dey kom meet am, make wi sing songs take tank am. Make wi sing psalms take praiz am.
So di woman stay with en pikin until e kon big. Wen Hannah don train am rish, e kon karry am with three melu, one bag of flower and one kontaina of wine, go God house for Shiloh.
I ask am for pikin and E don give mi wetin I wont.