Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 25:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Doz wey dey honbol, E dey help dem do wetin dey rite, bikos E dey tish dem en ways.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 25:9
28 Iomraidhean Croise  

Make Yu let mi follow yor kommand, bikos na der my happiness dey.


I bilive yor kommand and naw, make Yu tish mi how to judge well and to undastand yor laws!


Make Yu tish mi to do wetin Yu wont, bikos Yu bi my God and make yor Holy Spirit guide mi as I dey waka.


God dey support pipol wey nor dey karry body up, but E dey kill wiked pipol trowey.


bikos God like en pipol and doz wey honbol demsef, E dey make dem win.


Make doz wey dem dey opress, si food kon chop beleful. Evribody wey dey fine God, go praiz am and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.


E dey make mi strong. E dey guide and take mi pass di rite road, so dat pipol go honor en name.


My God, make Yu tish mi how I go live my life and bikos my enemies hide for korna dey wait to distroy mi, make Yu lead mi pass di rite road.


Yu dey guide and advise mi as Yu dey lead mi enter where glory dey.


My God, Yu dey judge di pipol wey dey do wiked tins kon save doz wey dem dey opress for dis world.


I dey follow korrect judgement and I always dey do wetin dey rite,


E go judge evribody akordin to wetin dem do kon defend doz wey nobody dey help. E go ponish wiked pipol and doz wey dey do bad tins, go die.


God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.


I go give una my spirit kon make sure sey una dey follow my laws and keep all di kommandment wey I give una.


Una wey dey honbol, make una ask make God bless and help una to follow en kommand. Make una do wetin dey rite and live betta life. May bi God go protet and save una from en vexnashon, wen E won distroy di world.


God go bless una wey nor dey karry body up, una go enjoy en promise for dis world.


Jesus ansa am, “Na mi bi di road, di trut and life. Nobody go fit go meet my Papa, unless e pass thru mi.


kon tell am, “Yu devil pikin wey nor like good tin, na so-so wayo and bad tins yu sabi do, yu nor go stop to dey oppoz God?


kon take pamishon to go Damaskus, so dat if e si anybody wey dey follow Jesus Christ wey bi di Way, weda na man or woman, e go arrest dem kom Jerusalem.


gentolness and to kontrol awasef. Di law nor dey against all dis tins.


bikos e give us dis new life and e go take us pass di curtain wey bi en body.


So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.


For una heart, make una make Christ una Oga God and make una ready to ansa anybody wey ask una about di hope wey una get.


Instead make e show sey Christ dey inside una and una don get gentol and kwayet spirit wey God go value.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan