make Yu listin and ansa dem from heaven. Make Yu forgive di king and Israel pipol for dia sins kon tish dem di rite way. Den, my Oga God, make Yu send rain kom dis land wey Yu give yor pipol as dia own forever.
My God, make Yu save mi as Yu dey lead mi, bikos my enemies dey korna dey wait to katch mi. Make Yu remove all di problem wey dey di road wey Yu dey take mi pass,
Naw, if really sey I dey good for yor eye, make Yu show mi yor way; so dat I go know Yu more-more kon kontinue to dey good for yor eye. Den I go si sey dis pipol, na yor pipol.”
and pipol go dey sey, “Make wi klimb go God mountin. Yes! Make wi go Israel God Temple, den E go tish us wetin E wont make wi do and wi go waka for di road wey E choose. Bikos betta tishing dey kom from Jerusalem and God dey tok to en pipol from Zion.
God tell en pipol, “Make una stop and look round. Mi, wey bi God, don tok. Ask for di old way wey bi God own and make una follow am.” But dem ansa, “Dat nor bi di way wey wi like to follow!”