Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 24:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Na who go fit klimb go God mountin? Na who go fit stand for en Holy Place?

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 24:3
19 Iomraidhean Croise  

David build many house for ensef for en own town. E still make one place for God Kovenant Box.


My God, na who go fit woship for yor temple? Na who go enter yor present for yor holy hill?


“I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”


But blessing go follow di pesin wey Yu choose to stay yor palis. Make di good tins wey dey yor house, yor holy place, beleful us.


God klimb go where high well-well. E don katch and put many pipol for prison. Even men wey sin well-well dey praiz Yu. True-true, di Oga awa God dey stay for der!


and God kon tell mi, “Man pikin, listin well-well to evritin wey yu hear and si. I go tell yu di rules and di laws for di temple. Listin well-well, so dat yu go know di pesin wey go fit enter and kom out from di temple and doz wey nor suppose enter.


Mi wey bi God wey get pawa, dey kommand una sey, strenjas wey neva sekonsaiz; doz wey nor dey obey mi, make dem nor ever enter my temple, even if na strenjas wey dey stay with my pipol.”


Moses tell Aaron, “Dis na wetin God tok: “ ‘Among di pipol wey dey klose to mi, I go show mysef holy to dem and for where evribody dey, na der dem go for honor mi.’ ” So Aaron nor tok anytin.


“Si! I dey send my messenja kom and e go prepare di way for mi. Den Oga God wey una dey find, go kom en temple at wons.


Simon Pita kon tell am, “Oga God, where yu dey go?” Jesus ansa, “Una nor go fit follow mi go di place wey I dey go naw, but una go kom meet mi for der leta.”


Jesus ansa am, “Make yu neva tosh mi, bikos I neva go meet my Papa for heaven. Go meet my brodas, tell dem sey, ‘I dey go heaven go meet my Papa, wey bi yor Papa too; my God, wey bi yor God too.’ ”


Since wi don receive di kingdom wey dem nor fit skata, make wi tank and woship God with respet and fear. Make wi gi-am di kind woship wey go make belle sweet am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan