Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 23:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 E dey give mi food to chop for my enemies present. E pour oil for my head and my cup kon full dey trowey.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 23:5
23 Iomraidhean Croise  

God remove yu from trobol kon make yu dey save and yu get food full yor tabol.


wine wey go make us happy; olive oil wey go make awa skin good and bread wey go give us strent.


I go dance bikos E diliver mi kon praiz God name forever.


My God, na Yu dey make mi strong and prosper; Yu don give mi betta future.


Make doz wey dem dey opress, si food kon chop beleful. Evribody wey dey fine God, go praiz am and dia heart go dey happy with joy wey nor dey end.


Make rish pipol for di world kom woship am. Evribody must bow to am, plus doz wey don die and doz wey nor fit save dia own life.


Yu love wetin dey rite kon hate wiked tins. So Oga wey bi yor God don anoint yu as E pour en oil for yor head kon make yu high pass any oda pesin.


Dem even tok against God ensef wen dem sey, “God nor fit give us food for di wildaness.


But Yu don make mi strong like melu wey dey bush and use oil wey fine pass, take anoint mi.


My eyes don si my enemies dey fall and my ear don hear as God win doz wiked pipol.


For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.


Una dey drink wine from di basin wey una dey use for sakrifice and dey spray betta perfume for body, but una nor kare about Israel land wey don skata.


But wen una dey fast, make una wosh and rub pomade for una face,


Yu nor pour oil for my head, but dis woman don anoint my leg with oil wey dey send well-well.


Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.


Wen wi drink from di Oga God Supper cup, dat mean sey wi dey share from Christ blood. Wen wi chop from di bread wey wi divide, dat mean sey wi dey share for Christ body.


Na God make wi and una dey sure sey wi dey inside Christ. Na God choose us from odas


So, make all di glory bi God own; di Pesin wey dey do pass di tins wey wi go fit ask or tink, thru en pawa wey dey work inside us.


But di pesin wey dey holy, don anoint una and all of una know sey na true.


As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan