4 Even doh I waka pass di place wey dark pass and where deat dey, I nor go fear anytin, bikos E dey with mi; en rod and staff dey protet and konfort mi.
So make una nor fear, bikos I dey with una! Na mi bi una God, so make anytin nor make una fear! I go make una strong kon help una and I go protet and save una.
Dem nor even ask sey, ‘Where God wey take us komot from Egypt? Di Pesin wey take us pass wildaness and desert, land wey nor good and dey dry, where pipol nor dey stay or travel pass.’
Naw, my God, make Yu protet yor pipol with yor shepad stik. Make Yu lead yor pipol wey dey special for yor eye. Even doh dem dey stay alone for bush, make yu let dem chop betta food wey dey Bashan and Gilead, just as dem dey do before.
God wey dey lead heaven sojas sey, “For dat time, ten strenjas go kom meet one Jew pesin sey, ‘Wi won share from yor blessings, bikos wi hear sey God dey with yu.’ ”