God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”
Dem take shuku-shuku make crown wear am for en head, put walkin stik for en hand, den knee down for en front kon dey laf am dey sey: “Make una hail Jew pipol king o-o!”
Pipol wey dey waka pass kon dey shake dia head and dey tok bad about am sey, “Eehen! Yu wey sey, yu go fit distroy di temple kon build am again for three days.
Herod with en sojas too dey take Jesus make yeye and dey laf am. Den Herod sey make dem wear fine klot for Jesus body, den make dem take am go back go meet Pilate.