24 Bikos E nor leave or forget poor pipol as dem dey sofa. E neva turn en back to dem, but E dey listin to dia kry for help.
Wen I dey trobol, I pray to God and E ansa kon free mi.
My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa. Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
But naw, I don turn worm instead of man. Evribody hate and dey laf mi!
I pray to God as I dey sofa and E ansa mi; E save mi from evritin wey dey worry mi.
I go praiz God with all di bones wey dey my body kon sey: “Na who I wont take kompare with my Oga God? Na who go fit save pipol wey nor strong from pipol wey strong? Na who go fit protet pipol wey nor get help and poor pipol from tif?”
Nor leave yor savant, bikos I dey trobol, but make Yu ansa mi naw-naw!
So, Jesus shaut, “Papa, I put my spirit for yor hand!” Afta e tok finish, e kon die.
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.