20 Make Yu save mi from di swod kon guide my life from doz dogs.
My Oga God, make Yu raiz-up! Make Yu stand against dem kon nak dem fall! Make Yu use yor swod take save mi from wiked pipol!
My God, na so Yu go just dey look dem? Yu nor go do anytin? Make Yu save mi from dis lions wey won kill mi!
Make shame and disgrace follow di pipol wey dey try to distroy mi. Pipol wey dey happy bikos I dey sofa, make disgrace follow dem.
Make Yu kom near and save mi! Make Yu save mi from my enemies!
My Oga God, if I don do any wrong tin or dey guilty as dem tok;
Make shame and disgrace follow pipol wey won kill mi!
God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol