2 My God, na evriday I dey koll Yu, but Yu nor dey ansa. Na evry nite Yu dey hear my vois, yet I still dey sofa.
I dey kry both day and nite and na tears bi di only food wey I dey chop and my enemies dey tell mi sey, “Where dat yor God dey sef?”
My Oga wey bi God for Heaven Sojas, na how long Yu go dey vex for awa prayers?
My Oga God wey dey save mi. For day time, I dey kry give Yu and I still dey pray to Yu for nite.
Yu hide yorsef for di kloud, so dat awa prayers nor go rish where Yu dey.
I kry well-well make E help mi, but God nor gri ansa mi.
So e leave dem, go pray di same way for di third time.
una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem?
Jesus go mountin go pray and e dey der dey pray to God till day break.
Wi dey pray with all awa mind for day and nite sey, make God let us si una again kon let una know evritin wey una suppose know about una faith.
Anytime I remember yu for my prayer, weda na for nite or day time, I dey always tank God wey I dey serve with betta mind, just as my grand-grand papa dem serve am.