19 My God, nor dey far from mi! Na Yu bi my strent; make Yu kwik kom save mi!
My God, wetin make Yu stand far from mi? Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?
My God, I love Yu well-well and na Yu bi my strent.
My God, si as di king dey rijoice, bikos of yor pawa! E dey happy and shaut, bikos Yu make am win.
So, make Yu nor too stay far from mi, bikos trobol dey near and no oda pesin fit help mi.
So my God, abeg, make Yu save mi! Make Yu kwik-kwik kom help mi.
I dey poor and I nor get anytin, so make God keep mi for en mind. My God, make Yu kwik kom, bikos na Yu bi my help and di Pesin wey go save mi.
Dem don opress mi and I nor get anytin! Abeg my God, make Yu kwik kom save mi, bikos na Yu bi my helpa and di Pesin wey dey diliver mi! So make Yu kwik kom!