But dem wound am bikos of awa sin; dem beat am bikos of di bad tins wey wi do. Na di ponishment wey e sofa give us peace and en wounds don make us well.
“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.
Wen di sojas don nail Jesus for cross, dem tear en klot and dem for kon divide am. But dem leave di fine koat (bikos e nor get where dem join am, since dem weave-am from top go rish bottom).
Di oda disciples kon tell am, “Wi don si Jesus.” But e ansa dem, “Unless I si en two hand wey dem nail kon put my finger inside di whole wey di nail make and shuk my hand inside di whole wey dey en belle, I nor go ever bilive una.”
Den e tell Tomas, “Put yor finger for my hand, make yu tosh am. Stresh yor hand put inside di korna for my belle. Make yu nor dey doubt again, but make yu bilive.”