1 My God, my God, wetin make Yu forget mi? Wetin make Yu dey far from mi wen I dey kry for help?
Instead make I chop, I dey kry and my pain dey pour kom out like wota.
My God, wetin make Yu stand far from mi? Wetin make Yu dey hide wen I dey trobol?
My God, make Yu protet mi, bikos I don run kom meet Yu for help.
So, make Yu nor too stay far from mi, bikos trobol dey near and no oda pesin fit help mi.
My enemies gada round mi like many dogs and bad-bad pipol dey kom katch mi. Dem don shuk my hand and leg.
Make Yu nor let mi sofa with my enemies and nor kill mi with wiked pipol.
Bikos God like to dey judge well and E nor go ever leave doz wey dey fear am.
I don taya and my own don finish. I dey kry from my heart, bikos of all di pain for my body.
Dem dey sey, “God don rijet am. So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”
I dey kom judge and diliver my pipol. E nor go tey again and di time to save dem don near. I go save Jerusalem kon honor Israel pipol.”
Dem dey sofa and make us fear. Wi won si God, so dat E go save us from di opreshon and bad tins wey wi dey do, but e nor gri work.
Make dem grind am to pieces kon pour olive oil inside, bikos na korn ofrin.
Wen three oklok won rish, Jesus Christ kon shaut, “Eli, Eli, lema Sabaktani?” wey mean, “My God, My God, wetin make yu abandon mi?”
Around three oklok, Jesus kon shaut sey, “Eloi! Eloi! Lama Sabaktani?” Wey mean, “My God! My God! Wetin make yu abandon mi?”
Bikos Jesus dey struggol well-well for mind, e pray sotey en sweat kon bi like blood.
Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”
Make una nor love money and make wetin una get rish una, bikos God sey, “I nor go ever leave or abandon yu.”
Wen Jesus still dey dis eart, e pray and kry to God wey go save am from deat. God hear en prayers, bikos e obey God for evritin.
God nor go leave en pipol, bikos E don make promise with una grand-grand papa. God happy to make una en own pipol.