Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 21:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Yor viktory dey gi-am betta honor. Viktory with majesty wey make evribody know am for evritin.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 21:5
24 Iomraidhean Croise  

But Yu dey even do di ones wey pass dem. Yu don promise my shidren-shidren tins for many years wey dey kom and Yu, Oga God don let mi si dis tins.


And if yu obey and keep my laws and kommand, just as David yor papa do, I go give yu long life.”


And naw, Yu don choose to bless my family so dat wi go dey with Yu forever, bikos if Yu my God bless pesin, di blessing go dey forever.”


Di OGA tell my Oga God, “Make Yu sidan for where honor dey for my rite hand, until I don put all yor enemies under yor leg.”


E bi like di dew for Hermon wey dey flow from Zion hill. True-true, na der God for sey en blessings go always dey forever and ever.


But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive.


Make di king rule with God proteshon forever. Make yor love wey nor dey fail and faithfulnes, keep di king.


My viktory and honor dey kom from God. Na-im dey guide mi and na-im bi my Rock, so nobody fit kom attack mi for der.


Yu make dem bi like Yu kon give dem glory and honor.


Honor and majesty dey round am; strent and beauti dey en temple.


“Who bi dis pesin wey dey kom from Bozrah wey dey Edom? Who wear fine red klot dey waka kom with pawa and strent?” Na mi God wey dey speak with raitiousness, wey dey mighty and get pawa to save.


Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.


Wen Jesus don tok all dis tins finish, e look heaven kon sey, “My Papa, di time don kom wen yu go give glory to yor pikin, so dat yor pikin go give yu glory too.


I don give dem di honor wey yu give mi, so dat dem go bi one just as wi bi one:


And naw, Papa honor mi, make yu draw mi near yu, just as wi dey before di world start.


Wetin I mean bi sey: Wi get High Priest wey sidan for God rite hand side for heaven.


go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan