David take gold crown from Ammon pipol juju wey bi “God Milkom” and di gold heavy rish seventy-five pound and jewel dey inside am too. David take am kon wear am for en own head. E still karry many tins from di town.
Ammon pipol juju wear one gold crown for en head wey heavy rish 75 pounds and jewel dey inside am, so David kollect am put for en own crown. E still karry many tins komot from di town.
My Oga God, make Yu and di box wey dey show as yor pawa bi, enter and stay dis temple forever! Make yor priests si as Yu dey diliver pipol! Make doz wey dey obey Yu happy for di blessings and propaty wey Yu dey give!
Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.
even doh wi si Jesus wey angels big pass small, e nor too tey before God gi-am glory and honor, bikos e sofa and die for evribody, just as God plan am.
So Samuel take di horn wey olive oil full kon anoint di boy for en brodas front. God Spirit kon enter David body from dat day go. Den Samuel kon go Rama.