Yu send yor messenja make e kon boast for mi sey, yu use yor shariot and men take konker di highest mountin for Lebanon. Yu dey boast sey yu don kut di tall cedars and all di betta trees. And di part wey deep pass for di forest, yu boast sey yu don rish der.
King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
I dey shame to ask di king make e give us some sojas wey go guide us from awa enemies as wi dey travel, bikos I tell am sey, Awa God dey bless anybody wey trust am, but E dey ponish and vex with anybody wey turn from am.
But David ansa am, “Yu dey kom meet mi with swod, spear and javelin. But I dey kom meet yu with di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey yu dey shalenge.