Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 19:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 19:12
19 Iomraidhean Croise  

“Okay! Make una tish mi; make una tell mi my fault and I go kwayet listin to una.


Yu know wen I sidan or wen I stand up. Yu know wetin I dey tink even wen I dey far from Yu.


Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!


Trobol gada round mi and I nor fit kount dem! My sins don many well-well and I nor sure sey I go fit dey free from dem! Dem many pass di hair wey dey my head and I don lost all my hope.


Make Yu wosh and klean mi from di bad tins wey I do. Klean mi from all my sins.


Awa sins too many, so Yu don forget us, bikos wi nor dey hear word.


Yu know all di sins wey wi kommit; even di sins wey wi hide do, Yu dey si all of dem.


Den God tell Moses, “Make yu klimb di mountin and I go give yu di law and kommand wey I rite for small flat stone, so dat yu go fit tish di pipol.”


Pipol wey nor dey listin to advise dey ask for trobol, but doz wey dey respet di law, go susid.


All of us nor dey klean and dirty full awa life. Bikos of awa sins, wi bi like leaf wey don fade wey breeze dey blow trowey.


Na wikedness full human being mind and e bad well-well. Na who go fit undastand am?


My mind dey klear, but dat nor mean sey I dey innocent. Na only God go fit judge mi.


If to sey dem go just gri fear mi and obey all my kommand, e for dey well with dem and dia shidren-shidren forever.


So make una dey kareful kon do as di Oga una God kommand; make una nor turn go rite or left!


But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan