1 Di heavens dey show as God glory bi. Di sky dey show how en work big rish.
Na der E si wisdom kon test as e important rish, den E si sey e dey good.
Na God get di heavens, but E don give di eart to human being.
Na with di word wey God tok, E take kreate di heavens. E breath en word and all di stars for heaven, appear.
Make di heaven tok about how E take dey judge bikos na God go judge by ensef. Make di heavens tok about en good judgement, bikos na God bi di judge.
Wen I look di sky for nite kon si di work wey Yu do; di moon and di stars wey Yu keep for dia place,
But wise pipol go shine like lite for di sky. Doz wey tish pipol di rite tin, go shine like star forever and ever.