Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 18:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 So, God open di heavens kon kom down and dark kloud dey under en leg.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 18:9
17 Iomraidhean Croise  

E tear di sky open kon kom down with one black kloud for en leg.


Awa God dey kom and E nor dey kwayet at-all. Fire dey burn evritin wey dey en way and strong breeze wey dey make nois, dey round am.


So, make una sing to God! Make una sing praiz en name! Make una praiz di Pesin wey dey ride on-top kloud! Na God bi en name! Make una happy for en present!


Fire dey round God for front and E burn all en enemies for evry side.


Smoke kover Mount Sinai, bikos God land on-top di mountin with fire. Di smoke dey go up like oven own and di mountin kon dey shake well-well.


So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.


God go kom with fire. E go ride kom with di kloud kon ponish doz wey E dey vex for.


God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois dey make nois from Jerusalem and di eart with di sky kon dey shake. But God go defend and protet en pipol.


“Afta di wahala wey go happen for dat time, “Di sun go kon dark and di moon nor go shine; stars go fall from heaven and heaven go dey shake.


Wen twelf oklok for aftanoon rish, darkness kon kover di kountry until three oklok for aftanoon.


Jesus ansa, “Yu nor go fit undastand wetin I dey do naw, but yu go undastand am leta.”


Israel pipol, no god bi like una God. E dey kom help una from heaven and di sky with en wonderful pawa.


For dat time, en vois dey shake di eart, but naw, E don promise sey, “Nor bi only dis eart I go shake, but I go shake di heavens too.”


Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.


Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan