Jehoshafat go meet en pipol kon choose doz wey go dey sing and praiz God wey dey holy. As dem dey mash go meet di sojas, dem kon dey sey, “Make wi tank God, bikos en love na forever and ever.”
As Jesus still dey tok, Judas wey bi one of di disciples, kon kom. Plenty pipol wey di priest oga and eldas send, karry gun and big stik dey follow Judas for back.
By dis time, Jesus tell di pipol wey follow Judas kom sey, “Una karry swod and stik kon arrest mi like sey I bi tif? I dey tish inside di temple evriday, but una nor arrest mi.”