Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 17:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make Yu protet mi as pesin dey protet en own eye. Make Yu hide mi under yor feada.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 17:8
16 Iomraidhean Croise  

My God, make Yu protet mi, bikos I don run kom meet Yu for help.


My God, si as I value yor love wey nor dey fail! Evribody dey save under yor feada shadow.


Yu dey feed dem from di plenty food wey Yu get for yor own house kon let dem drink from yor wota wey dey give life,


My God, make Yu sorry for mi. Abeg, sorry for mi, bikos na Yu dey protet mi. I go hide under yor shadow until I don free from all dis wahala.


I kry to di Most High; di God wey dey supply evritin wey I wont


Make Yu let mi stay yor temple forever, den I go dey save under Yu.


Yu know wetin I promise and Yu don give mi di reward wey Yu dey give pipol wey dey obey Yu.


help and save mi. I dey sing for joy, bikos I dey under yor shadow.


Pipol wey dey stay where di Most High God dey, go dey save under en shadow.


E go kover yu with en feada and na der yu go dey save. Na en promise wey nor dey fail, dey guide and protet us.


Do wetin I tok and yu go get good life! Protet all wetin I tish yu just as yu go protet yor eye.


Bikos Oga God wey dey rule ova evritin tell mi sey, na bikos of en own glory E send mi go di nashons wey bin distroy una, bikos anybody wey tosh una, don tosh di pipol wey E love well-well.”


“O! Jerusalem pipol, O! Jerusalem pipol! Una wey kill di profets and stone di pipol wey God send kom meet una! I don dey try to gada una shidren as fawol dey gada en shidren under am, but una nor let mi do am.


“Jerusalem pipol! Jerusalem pipol! Una wey kill profets and stone pipol wey God send kom meet una! E don tey wey I won gada una shidren as fawol dey gada en pikin under en feada, but una nor gri!


Na empty dirty land for wildaness E for si dem. E dey look and guide dem for evry korna; E dey guide dem as pipol wey E love well-well.


God go bless yu for evritin wey yu dey do! Di Oga wey bi Israel God wey dey protet yu, go pay yu for all di good tins wey yu don do!”


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan