4 Make wi dance praiz am with sheke-sheke; make wi praiz am with jita and flute!
Dem dey dance, dey play sheke-sheke, harp and dey enjoy dia trumpet sound.
I nor fit remember di last time wen I hear betta music, bikos na only song wey go make mi mourn and kry, naim dem dey play.
My God, I go sing new song to Yu! I go use jita wey get ten rope take sing and praiz Yu.
Make una dance praiz en name with sheke-sheke and jita,
Make una praiz God with di sweet sound from jita; make una use harp take sing to am.
Na myrrh, aloe and kassia dem spray as perfume for yor klot. Dem dekorate yor palis with ivory and na harp dem take dey entertain yu for der.
with harp wey get ten rope and jita.
Den Miriam, Aaron sista wey bi profet kon take en sheke-sheke and all di rest wimen follow am too dey play dia sheke-sheke as dem dey dance.
So Oga God, Yu don heal mi. I go play harp to take sing and praiz Yu; I go sing praiz for yor temple as long as I dey alive.”
God wey get pawa dey give mi strent. E make mi stand strong for groun like deer kon keep mi save on-top di mountin. (For di kwayamasta: Make dem sing dis song with instrument like, jita.)