9 and dem dey judge dem just as dem rite am. God go fight for evribody wey dey serve am! So make wi praiz di Oga wey bi awa God!
Babilon pipol! God go soon distroy una. Di pesin wey go pay una back for wetin una don do to us, make happiness bi en own.
E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am and na dem bi Israel pipol wey dey klose to am. So make wi praiz God!
Israel pipol go dey save as dem dey stay der. Dem go build house kon plant vine for der again, den I go ponish all dia neighbour wey ponish dem before. Den dem go know sey na mi bi God.”
I go skata una juju shrine with dia Asherah juju kon distroy una towns.
I go make my lite sharp like swod and my hand go hold di judgement swod well-well; I go revensh doz wey make mi vex kon pay doz wey hate mi!
Bikos I bear rish di end kon follow my Papa sidan for en throne, anybody wey fit bear rish di end, go follow mi sidan for my throne too.