So Jerusalem, make yu go on-top high mountin. Make yu prish di good news! Koll Zion pipol with loud vois, den announce di good news! Shaut as yu dey tok and nor fear at-all. Make yu tell Judah towns sey God dey kom!
Si as e dey good to si messenja wey dey kom give una peace and good news from di mountins! E dey announce sey una don win kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”
En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.
I dey kommand sey, ‘Make evribody wey dey dis kingdom, fear and respet only Daniel God.’ “E go rule forever, bikos E nor dey die. Dem nor go fit distroy en kingdom and en pawa nor get end.
Dem gi-am authority, honor and pawa to rule. Evribody, nashon and pipol from difren tribe, go serve am. En pawa go last forever and nobody go fit distroy en kingdom.
“Den, Israel pipol, una go know sey na mi bi di Oga una God. I dey stay for Zion wey bi my holy hill. Jerusalem go bi holy town and strenjas nor go fit win am again.
Di sevent angel blow en trumpet and one loud vois kon shaut from heaven: “All di kingdom for di world don bi God and Christ own. E go rule forever and ever.”