3 God dey great! Na only en wi suppose to dey praiz! Nobody fit measure as E big rish.
Bikos God dey great and evribody must praiz and respet am pass oda gods.
But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”
“Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey.
Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.
Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.
Wi nor go fit undastand di great tins wey E dey do and all di wonderful tins wey nobody fit kount.
Di tins wey Yu know, too dey wonderful for mi; dem too big for mi to undastand!
Si as awa Oga God big rish! En pawa dey wonderful! Nobody fit undastand how God take dey know tins!
Si as awa God great rish! Wi go praiz am for en own town wey dey on-top en holy mountin!
God dey great! Make all praiz bi en own! E big pass all di oda gods.
Una nor know? Una neva hear? God go dey forever. Na-im kreate di whole world. E nor dey taya or weak. Nobody fit undastand wetin E dey tink.
Who fit know how God big rish? Who fit know how God wisdom and undastandin bi? Who fit esplain why God dey do wetin E dey do!
Dem dey sing Moses wey bi God savant and di Lamb song sey: “God wey dey mighty, si as di tins wey yu dey do dey big and wonderful! Yu wey bi king for all nashons. Yu nor dey do parsha and evritin wey yu dey do, na true.