Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 144:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Wi just bi like air wey dem dey breath; awa days bi like shadow wey dey fade go.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 144:4
16 Iomraidhean Croise  

One day, all of us go must die, bikos wi bi like wota wey pour for groun wey dem nor fit gada again. But God nor dey kill pesin, instead E go tink of how E go take bring di pesin kom back to ensef.


Awa Oga God! Yu know sey wi dey pass thru dis world like strenjas, just as awa grand-grand papa dem do. Awa days bi like shadow wey dey fade and wi nor fit run from deat.


yu tink sey E go bilive who E make from san; sometin wey bi dust wey fit skata like ant house?


bikos dis life wey wi dey so, short well-well. Wi nor know anytin at-all and awa days for dis eart bi like shadow wey go kwik vanish.


My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.


I dey fade komot dis life like shadow; I dey die komot like lokust.


Wen Yu ponish us for awa sins, Yu dey remove awa pawa like rat wey dey chop pesin food. But each of us, na just breeze wey dey blow pass.


Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.


Make Yu remember how my life short rish and how human being life empty and nor mean anytin!


As I tink about evritin wey human being dey do for dis world, I kon sey: Evritin dey yuzles; e just bi like sey pesin dey porshu breeze.


Di tisha sey, “Evritin dey yuzles! Yes, evritin really dey yuzles!”


So di tisha sey, “Evritin dey yuzles. Yes! Dem yuzles well-well.”


But wiked pipol nor go prosper, bikos dem nor dey fear God. Dia life go kwik finish like pesin shadow.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan