11 Save and diliver mi from my enemies pawa, bikos na lie-lie full dia mout and even doh dem swear sey dem go tok trut, na lie dem still dey tok.
Pipol dey lie give each oda; dem just dey deceive demsef.
E just bi like sey dem dey chop ashes. Di foolish tins wey dem dey tink don deceive dem and dem nor fit help demsef again or tell demsef sey, ‘Nor bi lie-lie God wi dey serve so?’ ”