Biblia Todo Logo
Bìoball air-loidhne

- Sanasan -




Psalms 143:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.

Faic an caibideil Dèan lethbhreac




Psalms 143:2
12 Iomraidhean Croise  

Wen yor pipol sin against Yu (bikos e nor get who nor dey sin) and Yu vex kon let dia enemies defeat and karry dem like prisonas go anoda land. Even if di land far well-well,


Yu dey open eye look dis kind pesin? Yu go gri judge mi so?


Any human being fit dey klean? Anybody fit dey rite before God?


Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure?


E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am?


If to sey Yu, my God won kount all di sins wey pesin kommit, den na who go fit stand before Yu?


I dey keep my promise to tazon generashons. I dey forgive evil and sins. But I nor go fail to ponish wiked pipol with dia shidren-shidren. I go ponish di third and fourt generashon, bikos of wetin dia papa do naw.”


bikos e nor get anybody for dis world wey dey good well-well and nor dey sin.


Nobody dey good for God eye, bikos e dey obey di law. But na thru di law, wi take know wetin sin mean.


Wi know sey nobody dey free from God judgement, bikos na so di law tok and pipol go only dey free, if dem get faith for Christ. Since wi don bilive Christ, wi suppose to dey do good thru di faith wey wi get for Christ and nor bi to dey do wetin di law tok and wi nor go dey free from judgement, wen wi do only wetin di law tok.


If wi sey wi nor dey sin, dat mean sey, God dey lie and di trut nor dey inside us.


Lean sinn:

Sanasan


Sanasan