Na nite wen I dey sleep Yu take test my mind kon shek my heart. Yu don shek mi kon si sey I nor dey wrong. I don sey I nor go sin with wetin I dey tok or do.
Human being bi like ordinary dirty wey breeze dey blow and pipol wey feel sey dem strong, nor get pawa at-all. If yu go measure dem for skale, all of dem togeda nor heavy rish air.
Wake-up for nite, make yu kry. Pour all yor heart like wota before God! Raiz yor hand as yu dey pray to am and dey beg for yor shidren wey dey faint, bikos honga won kill dem.