7 Just as pesin dey klear and dig groun, na so too wiked pipol bones skata for dia grave mout.
Yet bikos of am, dem dey kill us evriday; dey trit us like sheep wey dem won kill.
Fear go katch dem and na di kind fear wey dem neva si or hear before. God go skata yor enemies bones. God go disgrace dem, bikos E don rijet dem.
As dem rite am, “Bikos of una, wi dey face deat from morning go rish nite and wi bi like sheep wey dem won go kill.”
True-true, wi tink sey wi go die. But dis happen so dat wi nor go just trust awasef, but wi go trust God wey dey wake pipol from deat.
Dem stone some; use saw kut some into two; take swod kill some; some wear goat and sheep skin dey hide waka and dem nor get anytin; dem sofa some and trit odas anyhow.