8 So make Yu nor let wiked pipol win mi, nor let dem susid with dia evil plan, if not, dem go dey proud.
Wen dem tell David sey Ahitofel don join Absalom against am, e kon pray, “Oga God, I beg! Make any word or advise wey Ahitofel tok, dey yuzles!”
Bikos Yu don give yor kings viktory kon save yor savant David from en enemies swod.
Nor let mi fall enter dia hand, bikos dem dey akuiz mi for wetin I nor do and dem always dey treaten mi.
But I nor go like how di enemies go si am, bikos dem nor go undastand and dem go sey, wi too get pawa and nor bi God do all dis tins!’ ”